Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, PSG win di first leg 5-4 for dia home but e neva be ova

Read am in 5 mins

As Arsenal beat Atletico Madrid to reach dia first Uefa Champions League final for 20 years, fans go turn dia focus to Germany.

Bayern Munich dey host defending champions PSG for di Allianz Arena.

Di winner go jam wit Arsenal for di Champions League final wit Arsenal for Budapest.

Dis dey happun one week afta di two teams jam each oda wey end 5-4 for PSG for dia home for Paris.

Football fans and oda sabi pipo say di first leg of di fixture na di “final bifor di final” sake of say di game sweet well well.

Both teams bin show dia attacking power for dat game – later for Wednesday dem go get anoda chance to see who go enta di final wit Arsenal.

PSG comot Liverpool to reach dis semi-finals wey Bayern Munich comot Real Madrid.

To reach dia second straight final, PSG gatz beat Bayern Munich for dia home – team wey don dey give dem wahala for di last few seasons.

For di Bavarians also, dem for win by two or more goals to qualify for di final afta dem already win dia domestic title.

Unlike di Arsenal vs Atletico game wey no offer any fine football, fans dey expect say dis one go give dem value for dia moni and time.

Bayern hopes to reach the final

Wia dis foto come from, ALEXANDER HASSENTEIN/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Apart from Serge Gnabry and Achraf Hakimi wey dey injured, all di oda players dey available

Wetin di two coaches tok

Afta di end of di first leg, PSG coach Luis Enrique say im neva dey involved for game like dat bifor – game wey produce nine goals.

But im sabi say di second leg for Germany go dey different from di one dem play for Paris.

“Di magic of di Champions league don dey give di players special energy,” Enrique tok.

Im add say “evribodi wan dey dia and make di most of di game, all di players apart from Quentin Ndjantoo dey available”.

PSG winger Khvicha Kvaratskhelia wey score two goals for di first leg for Paris, dey expect ogbonge game.

“For di league phase, we no play well against Bayern – I bin dey remember dat game well well, we also get plenty injuries at dat time.”

“But for di second half of di first leg for Paris, we play beta wey we show wetin we fit do. We show say we dey capable to beat dem only say we no score di goals we suppose score dat day,” Khvicha Kvaratskhelia explain.

Bayern coach Vincent Kompany also dey ginger imsef for dis game.

“We already bin beat Real Madrid wey we don sama PSG also for Paris for di group phase, but dem still be defending champions”.

Kompany add say “If any team dey dis world wey fit take dis challenge against PSG, ibi we [Bayern]. We sabi how good dem be, but we want win dis game”.

Bayern Defender Dayot Upamecano wey also score one of di four goals for Bayern last week, dey focused.

“Na big match for us. We dey focus for our own game. We wan win di game.”

Upamecano also add say “PSG get great players and super squad but we don dey focus for our own team wey we wan win di game”.

Anything but a win of more than two goals could see Bayern out

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, PSG dey hope to win back-to-back UCL titles, but dem gatz overcome free-scoring Bayern Munich first

Team news update

Bayern striker Harry Kane be di top-scorer for di Champions League dis season wit 13 goals, three more dan PSG forward Khvicha Kvaratskhelia (10).

Kane go hope to score more to lead di team to di final.

Coach Kompany gat almost all di full squad ready for dis game.

Raphael Guerreiro train wit di team afta im return from hamstring injury, na so Lennart Karl also return from injury.

Na only Serge Gnabry wey no dey available sake of im long term injury wey dey rule am out of di World Cup.

For di defending champions, na only captain Achraf Hakimi wey go miss sake of injury.

All di oda key players like Dembele, Neves, Doue, Vitinha and Kvaratskhelia dey available.

Bayern: Neuer; Stanišić, Upamecano, Tah, Laimer; Kimmich, Pavlović; Olise, Musiala, Luis Díaz; Kane

Paris: Safonov; Zaïre-Emery, Marquinhos, Pacho, Nuno Mendes; Vitinha; João Neves, Fabián Ruiz; Doué, Dembélé, Kvaratskhelia

Di game go happun at 7 PM GMT (8PM WAT) for di Allianz Arena stadium for Germany.

Make you join us for live commentary for dis ogbonge game wey go show which team go meet Arsenal for di final for Budapest on 30 May 2026.

Fonte do Artigo